#MUNARS REVIEW & #ARSHUD PREVIEW
Dec 07, 2018•3 min•Transcript available on Metacast Episode description
#MUNARS REVIEW Na 2-2 e take finish for old trafford on wednesday night as Arsenal been extend dem unbeaten run to 20 games this season. Once again this Arsenal don show say dem be side wey other teams for de pl no fit bully dis season. We bin keep our discipline well for the face of physical opposition, as we maintain our style of play and possession for old trafford. With this draw so, Arsenal don go 20 games unbeaten in all competitions, our longest run since 2007, when the side been rack up a club record 28 matches without defeat. This na the first time this season wey we no win de match wey we take lead, but e no too bad since na for venue where we never win league match for 12 years. As we still avoid defeat so, at all at all na him bad pass. Hard work and togetherness be wetin help the Gunners come through another intensive Premier League test. Meanwhile, we go dey disappointed if the english fa no take action against marouane fellaini sake of the hair pulling incident with guendouzhi. The matter don turn viral content for social media as arsenal fans dey call for disciplinary sanctions against the belgian international. Meanwhile when dem ask our coach unai emery about de mata, e talk say maybe time don reach for our 19 year old young star to cut him hair. Sad news regarding rob holding as we dey hear say the defender tear him knee ligament for de injury wey hin get on wednesday night. Report wey reach our ear talk say him fit miss the rest of the season so. We go face Solihull Moors or Blackpool for the third-round of the FA Cup on Saturday, January 5. Kick-off na 5.30pm (UK time) #ARSHUD PREVIEW...
Anyway Arsenal go dey in action this weekend against huddersfield town for de emirates. Arsenal don win dem 2 Premier League meetings with Huddersfield Town last season (5-0 at home, 1-0 away) and dey unbeaten for 10 matches against them for all competitions. The Gunners don win 16 of dem last 17 PL matches from 3pm on a Saturday, including each of the last nine. The only exception for that run na de 0-0 draw against Middlesbrough for October 2016. Although Huddersfield don win one of dem last 10 PL away matches, dem never lose back-to-back fixtures away for de competition since March. Huddersfield don lose eight of their last nine top-flight matches against Arsenal, failing to score in each defeat. Referee: Paul Tierney
Kick off na 3pm uk time, 4pm west africa time. #wearethearsenal #arsenal #Arsenalfc #arsenalfan #arsenalfans #arsenalfantv #arsenalday #arsenalstrength #arsenaltoday #arsenaltillidie #arsenal4life #ArsenalNation #arsenalforever #arsenallegend #ArsenalTillDie #arsenalforlife #arsenaltv #arsenalnigeria #arsenallondon #ArsenalPlayer